Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Atletico dey eye Rodriguez

Atletico Madrid dey plan to move for Real Madrid floppy wey be James Rodriguez. Dem don link the Colombian playmaker name with waka go Napoli but Atletico say dem ready to give am chance to stay for the Spanish capital.

According to yarn from Spain, Rodriguez like to stay for Madrid and waka go Real city rivals fit favour am. As e dey so Rodriguez dey Copa America dey prepare for Colombia quarter-final kasala against Chile on Friday.

 

James bin go ontop two-year loan deal for Germany with Bayern Munich but dem no gree sign am ontop permanent deal and so e don go back Madrid who now dey find way to sell am.

 

If James sign for Atlético, e go be the second player dis summer to switch from the Bernabéu for the Wanda Metropolitano.

 

Only Last week, midfielder Marcos Llorente bin join Los Colchoneros ontop five-year deal, and that one don make am the first Real Madrid footballer to make dis kine switch since José Manuel Jurado for 2006.

The post Atletico dey eye Rodriguez appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Nigeria must be careful in the Pursuit of Lookman – Rohr

Eze Creates Championship Record In QPR’s Defeat Vs Barnsley 

Philomina Ngozi

Jamilu Collins highlights Rohr’s man-management skills

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy