Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Bayern don comot hand for Sane kpake

Bayern Munich don comot mind of kpakeing £100million deal for Manchester City winger wey be Leroy Sane dis summer.

As e dey so the German dey ready now to go join the Premier League champions for their pre-season waka of Asia and e dey part of their squad for the season wey dey come so.

 

Na Sane be Bayern Munich koko target as dem dey try replace Arjen Robben and Franck Ribery wey waka comot from the Bundesliga champions.

 

Sane no wan force waka comot even though say Pep no too play am for the Eithad last season.

 

E don appear 47 times for Pep Guardiola side last campaign, e score 16 goals as the club kolobi domestic Treble.City kpake the League Cup and FA Cup join their Premier League title wey dem retain.

 

Bayern Munich now don shook eye put again for Chelsea starlet Callum Hudson-Odoi side. Dem dey also target Dalia Yinfang winger Yannick Carrasco and Barceona Ousmane Dembele.

The post Bayern don comot hand for Sane kpake appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

UNSMIL Statement on the Deteriorating Situation in Southern Libya, the Shutting Down of Sharara Oil field APO Group – Africa-Newsroom: latest news releases related to Africa

Valverde Happy Barca Still Atop LaLiga Despite 3-Game Poor Run

Chelsea Set To Break Club Policy And Offer Willian Two-Year Contract Extension

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy