Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Sell Ozil, kpake Ziyech for half price – Overmars

Before b4 Arsenal player and Ajax oga Marc Overmars don come out to tell Arsenal say make dem offload Mesut Ozil go kolobi Hakim Ziyech for half the price sake of say e better pass the German but Arsenal no gree hear im advice.

Transfer yarn don continue to dey circulate around German playmaker Ozil for north London.

 

Ever since Ozil waka come London na so so questions dey about im value to the Arsenal cause and Whether e go fit inside the system wey Gunners oga Unai Emery dey use.

 

Overmars wey play under  Arsene Wenger for the Premier League, believe say im get the solution to the transfer thing.

 

Overmars na the director of football for Ajax and e believe say im work with one player wey fit be better kolobi for Arsenal ontop sporting and financial level.

 

Overmars say Ziyech na better player wey don contribute 21 goals and 24 assists to Ajax waka last season.

The post Sell Ozil, kpake Ziyech for half price – Overmars appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Club Brugge Want Borussia Dortmund To Pay 20 Million Euros For Dennis Emmanuel Bonaventure

Philomina Ngozi

Salisu Yusuf not worried about Rangers lack of goals

Philomina Ngozi

Kano pillars Boss Musa wants fresh Pre-season ahead League resumption

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy