Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Competition for football top level na wash – Napoli Presido

Napoli presido wey be Aurelio De Laurentiis tok say make dem stop to dey play the Champions League and Europa League.

Every club for Europe dey carry their gbejero eyes put for the Champions League as na the ogbonge trophy for club level and thats why the best clubs wey dey across Europe dey gbege each other for the group stage and knockout competition like say tomorrow no dey.

 

Meanwhile, the Europa League dey act as the second tier event for teams wey their level no reach those wey dey for the Champions league but the winner dey get chance play for the CL with automatic qualification go the next season Champions League.

 

The format don dey work wella for many years now but Napoli oga wey be De Laurentiis don propose say make dem comot the two competitions, come replace dem with one 80-team strong super league competitions.

 

The 2018-19 Champions League don see Ajax, Tottenham, Barcelona and Liverpool reach the last four, while plenty big teams don cry go house after dem fall yakata comot.

 

De Laurentiis say im no dey ok with the way the competition dey as e believe say few teams dey take centre stage above all others every year and for am,  that one no make sense.

The post Competition for football top level na wash – Napoli Presido appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

La Liga Round 25 Preview: Barcelona Face Tough Test Away To Sevilla

Owen Off His Trolley With Big-Club Comparison

Philomina Ngozi

Osimhen plays down comparison with Ighalo

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy