Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Daniel Levy wan discharge Eriksen sharperly

Tottenham say dem go listen to offers wey dey under £40million for Christian Eriksen for January as chairmo Daniel Levy dey push to sell am sharp.

 

The Danish star go dey out of contract and dey eligible to waka comot from Spurs for nothing not even shikini money next summer and e don already tok say im no go carry pen sign any chacha contract under manager Jose Mourinho.

 

Eriksen don already tell nnayi ukwu Mourinho say im wan go try new challenge dem an im go  prefer to go Spain or Italy. E don reject new deal wey dey over £200,000 per week.

 

According to yarn wey dey come out from inside England, tori say Levy dey determine say im no wan allow Eriksen to waka comot for nothing and so e dey ready to entertain offers wey dey below the £40m mark.Eriksen bin no gree go  United as e make am clear say im no wan sign for another Premier League club, and shook eyes don come from Real Madrid and Atletico Madrid.

The post Daniel Levy wan discharge Eriksen sharperly appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Substitute Chukwueze Inspires Villarreal To Thrilling Pre-Season Win

Philomina Ngozi

CAFCL: Lobi Stars In Make Or Mar Clash Vs Mamelodi Sundowns Today

Philomina Ngozi

Balogun Applauds Brighton Fans For Massive Support In Home Draw Vs Arsenal

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy