Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

E go hard De Ligt to keep im place

Holand oga wey be Ronaldo Koeman don suggest say Matthijs de Ligt chance to carry retain im place for the Netherlands starting line-up fit reduce if e continue to dey start ontop bench for Juventus.

The 19-year-old bin waka move go Turin from Ajax for kpogiri wey reach £68 million ($84m) for July, as e end im 11-year association with the Dutch giants.

De Ligt bin kolobi the big kpogiri waka after im ogbonge 2018-19 season wey see saw Erik ten Hag side kpake domestic double come still reach the semi-finals of the Champions League.

The smallie centre-back bin appear 55 times across all competitions,and e come attract plenty attention from plenty top European clubs including Manchester United, Barcelona and Paris Saint-Germain.

After plenty months of tumbu tumbu De Ligt finally decide say na Juventus be the best place for am to continue im development, but since then he still never make im competitive debut for the club.

The b4 b4 Ajax star na unused substitute wen Juve kpokpo Parma 1-0 on Saturday. E even tok say e surprise am as coachee Maurizio Sarri no use am.

The post E go hard De Ligt to keep im place appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Omeruo Disappointed With Leganes Home Draw Vs Valencia

Philomina Ngozi

Why New Rumours Have Surfaced Linking Mbappé With A Move To Liverpool

Philomina Ngozi

CAFCC: MFM Knocked Out By Mali’s Djoliba

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy