Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Falcons fall yakata for Canada hand

After the kpokporisation of Icelandic side wey be UMF  Selfoss, Naija Super Falcons no fit repeat the same against fellow World cup bound team wey be Canada for the Pinatar Arena women football festival as dem fall yakata 2-1 for Spain.

 

Tori wey dey say Canada coachee wey be Heiner-Moller happy wella say dem play Naija as dem get another African for their World cup group E wey be Cameroon and dem believe say dis na another way to carry test their strength and ready for the World cup.

 

As of half-time Nigeria bin dey lead with goal wey Desire Okparanozie score for the 26th Min but the Canadians come back for the second half with vexation to level up with goals from Janine Beckie(47mins) and Sophie Schmidt (53Mins) to kolobi the game 2-1.

 

Plenty improvements dey for the Nigerian ladies side but dem still need work to do as dem go jam tough opponents for group A that is France , Norway and South Korea.

 

Canada wey be number 5 for World bin start their waka against England women and dem kpokpo dem 1-0 and now dem don beat Naija 2-1 to take continue their ogbonge waka for the Pinatar Arena women football festival.

 

Canada go start thier world cup waka for France against No. 46 Cameroon before facing No. 19 New Zealand and the eighth-ranked Netherlands.

The post Falcons fall yakata for Canada hand appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

2019 AfCON Qualifiers: Onyekuru Doubtful For S/Africa-Nigeria Clash Over Injury

Special Ones! Emmanuel Amunike joins exclusive group with Stephen Keshi

Philomina Ngozi

Alex Iwobi up against Salah, Mane and Auba for Player of the Year Award

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy