Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

HSBC London Sevens go shele for weekend

Tori say the skippos of the 16 teams wey go compete for the HSBC London Sevens  jam for Kensington Palace as den dey ready for the round of the HSBC World Rugby Sevens Series 2019.

Den fit decide all the four Tokyo 2020 Olympic Games qualification places dis weekend if the top teams finish with margin wey reach 22 points or more ahead of the fifth-place team wey currently be England.

 

Teams wey dey the other end of the standings go feel the pressure for the gbege to avoid relegation. Na only two tournaments remain dis season and with the four points wey dey separate Kenya, Wales and Japan naim be say every match na do or die.

Tom Mitchell wey be Host England Skippo no go dey around dis weekend, na  Phil Burgess go stand in for am for Wetin go be im 50th World Series tournament.

Action  go start  for Twickenham on Saturday as Australia go battle Wales for the first of the pool games.

The post HSBC London Sevens go shele for weekend appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Serie A round 21 Preview: Milan Host Napoli In Key title Test For Visitors

Tomiwa Dele-Bashiru Opens Up On Decision To Dump England For Nigeria

Philomina Ngozi

Agu Relishes Appearance For Super Eagles Against Uganda Cranes

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy