Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

I wan more chance to play – Zaki

One player wey no happy as e dey so na Godwin Zaki wey dey strike for Enugu Rangers as aproko wey dey say the player no like as im no dey get chance to ginger im swagger for the Flying Antelopes for the naija Professional football league.

The striker say im happy as strikers wey get chance play dey helep the team and im go continue to do im best to make sure say im sef contribute im own quota to the team.

 

The flying Antelopes dey ginger wella as dem get 31 points from the 16 games wey dem don play so far for the Group A of the NPFL, na one game dem don lose from 14 league matches.

 

Based on the kine form wey the team dey now e be like say dem go kolobi their 8th title wen season end. Already the Enugu base club don fall yakata como from the Caf Confederations cup so dem go wan kolobi at least the title for house and from there maybe qualify for continent again join.

 

Tori say both the management and the state government dey try to make sure say the team happy and dey the right frame of mind to continue to dey bring better result come.

 

Zaki hope say more chance to play go present imself as im ready to show im ginger anytime coach Gbenga Ogunbote give am chance.

The post I wan more chance to play – Zaki appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

12th AAG: Falconets Thrash Algeria 3-0 To Reach Women’s Football Final

Philomina Ngozi

20 Years After – Nigeria to participate in World Squash Championship

Philomina Ngozi

Football Agents Set To Lose Fortunes Due To Coronavirus Crisis

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy