Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Messi don pass Ronaldo for Golden shoe as e kolobi number six

Barca starman wey be Lionel Messi don kolobi im number six European Golden Shoe and na the 36 La Liga goals wey  e score for the Spanish Champions helep am kpake am and comot small boy wey dey play for PSG Kylian Mbappe for the setting.

Golden shoe na the award wey dem  dey carry give player wey score pass others for any of Europe top-flight leagues den and na the third  consecutive year wey Messi go win am be dis.

 

Mbappe bin need to score five goals for PSG Life 1 final match to take collect am but na only one goal the Frenchman manage score for the 3-1 Tamara falling for Reims.

 

Mbappe finish the season on top 33 goals while Messi finish on top 36 goals wey come in 29 starts for I’m team Barcelona. Cristiano Ronaldo wey win the award last for 2014/2015 season finish on top 21 goals for im first season for Italy.

 

Dis award wey Messi collect now don make am get more Golden Shoes pass Ronaldo.

The post Messi don pass Ronaldo for Golden shoe as e kolobi number six appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Virgil van Dijk is the most frustrating opponent – Abraham

Philomina Ngozi

Sikiru Alimi Staying With Lobi Stars For Next Season

Philomina Ngozi

Dennis reveals highlights of 2019/20 season

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy