Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Naija dey tough group for AFCON – Rohr

As e dey so, the  Afcon 2019 draws  wey  shele  for inside Egypt  put  Nigeria for Group B together with Guinea, Madagascar ati Burundi.

Na two first timers dey the Super Eagles group and dis one come make am be like say na the group easy pass.  But according to wetin naija coachee wey be Nnayi Ukwu Gernot Rorh yarn,  e say Naija dey group wey tough wella  for the 2019 Africa Cup of Nations .

Even though say naija get two Johny just come wey be Madagascar and Burundi  for their group , the German believe say the Eagles get plenty work to do to carry come out of the group.

 

E say make anybody no write off any of Guinea, Madagascar and Burundi because for den to even qualify show say dey no be referee at all so therefore den no go use small eyes take dey look dem.

 

Rohr,  bin dey the Egypt to use I’m korokoro eyes witness the draws wey shele for  Egypt capital wey be Cairo. E Don also expose plan of  the Super Eagles to rise chest against Ghana  and Senegal to take prepare for the tournament proper wey go start on June 21.

 

Nigeria bin miss the last two editions of the African Nations Cup but  qualify for the 2019 after den top Group E. The Super Eagles go begin their Afcon 2019 Waka  with Kassia against Burundi on June 22 before den go come face Guinea  on June 26 and Madagascar on June 30.

The post Naija dey tough group for AFCON – Rohr appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Samuel Kalu spared PK embarrassment as Bordeaux picks first win of Season

Philomina Ngozi

Blessing Onyebuchi and Mercy Genesis wins historic gold and silver at the world beach wrestling

Philomina Ngozi

Victor Osimhen finishes as Top Scorer in Belgian League Playoffs

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy