Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Renard fit go back to club coaching

Tori say Morocco coach wey be Herve Renard dey among candidates wey go replace Bruno Genesio for Lyon.

Already e don dey ready to carry the North African country enter the 2019 Africa Cup of Nations (Afcon) and e don tok say na that one be the koko for now.

 

Bruno Genesiodon tok say im go comot hand for the club wen season end. Other candidates wey the club don write their name down as replacements include Jose Mourinho, Patrick Vieira, and Claudio Ranieri.

 

No be today the 52 year old don dey involve for club level ,After e carry Zambia go kolobi their first ever Africa Cup of Nations title for 2012,e come comot go join Sochaux for the French top-flight for 2013.

 

After that one e come go join Les Lionceaux  but e no come fit deliver dem from relegation water.

 

E come come back Africa where e coach Cote d’Ivoire for 2015 that same year e waka enter France again where e come coach Lille before dem come nack am akpako sack.Now wey e don qualify the Atlas Lions of Morocco, dem don samma am better five-year deal wey go keep am for the North African country reach 2022.

 

Even though say Renard no dey too do well for Club level , e tok say im go like go back the French top-flight one day.

The post Renard fit go back to club coaching appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Onyekuru Blasts Former Anderlecht Coach After Missing 2018 World Cup

Philomina Ngozi

“We want to retain the title we won last year”- Ebiki Timimi

Philomina Ngozi

Ejaria urges Solanke to leave Anfield amid transfer talk

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy