Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

South Africa government wan appeal CAS ruling ontop Semenya

South Africa’s government has said it wants an appeal to be lodged against rules that force some female athletes to reduce testosterone levels. 

Olympic champion Caster Semenya had challenged the new regulations.

The South African government don come out to yarn say dem wan appeal against the Court of Arbitration of Sport (CAS) ruling ontop Caster Semenya matter.

 

Na early dis month CAS bin rule say female athletes wey get testosterone levels gat to start to dey take suppressive treatment so that dem go fit compete as women for certain events. The case don provoke debate about the right of athletes wey get differences of sexual development.

 

Tori say the South African government don instruct the national sports governing join body wey be the Athletics South Africa (ASA) wey get one kine amount of autonomy to go make the appeal after dem consult one expert panel.

 

Parties fit only appeal the decisions of the CAS ontop limited number of grounds. The Sports Ministry yarn say dem believe say two of the CAS judges no sure , say dem dey confused and say the judgment no look facts.

 

The International Association of Athletics Federations (IAAF)dey argue say higher testosterone levels for athletes wey get differences of sex development (DSD) — like two-time Olympic 800-meter running champion Caster Semenya,wey dey intersex i.e wey you no fit call man or woman but get male XY chromosomes — wey give dem more advantage over others.

The post South Africa government wan appeal CAS ruling ontop Semenya appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Etebo hails teammates after quarter final win over South Africa

Philomina Ngozi

AFCON 2019: Gambia Coach Saintfiet Invites El-Kanemi Goalie Jobe For Togo Clashes

Iwobi, Troost-Ekong, Balogun will be ready for South Africa – Rohr

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy