Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

SUPER FALCONS PLAYER EFIH DON JOIN LA LIGA CLUB

B4 b4 Rivers Angels midfielder and the latest Nigerian international wey go waka from the NWPL enter  the Spanish liga Peace Ewomazino Efih bin enter Spain dis August after e sign 1 year deal with sporting club de Huelva.

Peace na one of the few players wey don leave their mark for the NWPL wen she  play for only Edo Queens join the small time wey she play for the FA Cup for Rivers Angels for the beginning of dis chacha season before her movement go Spain.

The Spanish club don carry jersey no 20 give Efih and she sef  dey encoirage players wey dey house for obodo Nigeria to get hope and continue to dey work hard.

The midfielder dey part of Nigeria’ U20 women’s team wey reach the round of 16 under coachila Christopher Danjuma for the FIFA U20 women’s world cup for France for 2018.

She also follow for the home base Super Falcons players wey kolobi  the WAFU Cup for May dis year after dem kpokpo Côte d ivoire  for Final.

Peace hope say Nigerian players presence with better performance go open big big doors for the NWPL players to ginger for inside  Spain.

The post SUPER FALCONS PLAYER EFIH DON JOIN LA LIGA CLUB appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Euro Round-Up: Nwaekeme Scores Winning Goal For Trabzonspor , Musa Bags Assist In Al Nassr Win, 

Philomina Ngozi

AWCON 2018: Zambia Coach, Mwape Blames Lack Of Consistency For Defeat To Nigeria

Understanding Why Shehu Abdullahi And Ahmed Musa Are Still Important In The Super Eagles

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy