Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Super Six kasala Don start for inside Agege Stadium

Gbegerism to take determine who kpake league don start today for Agege  Stadium Lagos as Enugu Rangers wey dey group A of the Super six fall yakata 1-0 kondoto Entombed FC, Kano  Pillars and Akwa United come play 2-2 draw while Ifeanyi Ubah fall 3-1 to Lobi Stars.

Kasala go continue on Thursday for the Agege Stadium as Akwa United go play FC Ifeanyi Ubah , Rangers Int’l go jam Lobi Stars while Kano Pillars go gbege Enyimba.

Na round robin format dem adopt to take play the playoff wey start on June 4 and wey go end on 12 for Lagos.

 

Na three games dem go play every day and na Six NPFL teams dey involve to take know who go represent Naija for the two CAF Champions league spots and one Confederation Cup spot.

 

The six teams wey dey do battle na Kano Pillars, Akwa United, FC Ifeanyi Ubah, Lobi Stars , Enyimba FC and Rangers international.

Dis na the super six  fixtures

Matchday 01 – 04/06/2019

Enyimba Fc vs Rangers Internationals
Kano Pillars  vs Akwa United

FC Ifeanyi Uba vs Lobi Stars

Matchday 02 – 06/06/2019

Akwa United vs FC Ifeanyi Ubah
Rangers Int’l vs Lobi Stars
Kano Pillars vs Enyimba

Matchday 03 – 07/06/2019

Kano Pillars vs FC Ifeanyi Ubah
Lobi Stars vs Enyimba FC
Akwa United vs Rangers Int’l

Matchday 04 – 10/06/2019

Rangers Int’l vs Kano Pillars
Akwa United vs Lobi Stars
Enyimba FC vs FC Ifeanyi Ubah

Matchday 05 – 12/06/2019

FC Ifeanyi Ubah vs Rangers Int’l
Enyimba FC vs Akwa United
Lobi Stars vs Kano Pillars

 

Group A:

1. Rangers Int’l

2. Lobi Stars

3. Enyimba Int’l

 

Group B:

4. Akwa Utd

5. Kano Pillars

6. FC Ifeanyi Ubah.

The post Super Six kasala Don start for inside Agege Stadium appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Crazy Travelling Schedule for Super Eagles crucial 2nd-leg vs Libya revealed

Iheanacho Scores In Leicester City Win Over Cambridge United

Philomina Ngozi

Mikel, Olga Celebrate Seven Blissful Years As Couple

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy