Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

USA Shock France for U20 World Cup

United States Don carry better shock give  France for the  Under-20 World Cup wey dey shele for inside Poland. 

The French try overcome the early goal wey  U.S been score  but  Tab Ramos side come score two late goals wey come helep  dem enter last-16.

 

Everybody surprise as the United States take shock France wey many dey expect to win the tournament.  Dem samma France 3-2 akpako to take continue their Waka for Poland.

Justin Rennicks bin take advantage of the way wey France goalkeeper, Alban Lafont, no fit hold ball to take score  the winner for the 83rd minute and give the United States hope to continue for the tournament.  Dem bin dey 2-1 behind for the second-half.

 

Dis kimono against France now don helep the Americans move enter the Under-20 World Cup quarterfinals for the  third straight tournament, and now den go play Ecuador on Saturday.

 

The Americans bin start Ledezma and Paxton Pomykal sake of say starting midfielders Alex Mendez and Chris Durkin bin dey suspension and dem no dissapoint at all as Ledezma set up the first goal of the match with Soto opener.

 

Now the  United States to dey hope to reach the U-20 World Cup semifinals for the first time since 1989, when dem bin finish fourth.

The post USA Shock France for U20 World Cup appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Report: Arsenal Offered Chance To Sign World Cup Winner For Just £30m

Philomina Ngozi

Tornadoes Pip Rivers United 2-1, To Reach 2019 Aiteo Cup Final

Philomina Ngozi

AFCON 2019: Nigeria Vs Burundi Lineups, Kick Off, Team News

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy