Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Tennis na hard game to play for Naija – Blessing Samuel

Naija number one tennis player Blessing Samuel don tok say dis sport wey dem dey call tennis na expensive sport e be and say person wey no dey financially capable or wey no get sponsor no go fit play am.

 

She say tennis wey she dey play so if to say her papa no sponsor her maybe today nobody for dey hear her name. According to her, tennis na family game and she bin grow up dey see her papa dey play and just like the Williams Sisters, her papa begin dey coach her from small and naim inspire her to like come play the game.

Samuel say she no be jjc for the game as she don already play plenty international tournaments dem. As individual game e say Tennis hard sake of say right here for Naija to get sponsorship no easy and without kpogiri the game no go fit grow and the player no go fit improve sake of all the things e go need to play the game cost wella.

As per the one wey concern competition, e say Plenty tournament dey wey she don already line up to carry defend her title. E come carry advice give say the game of tennis require patience, focus and hard work and if person fit combine all dis, everything go work well.

The post Tennis na hard game to play for Naija – Blessing Samuel appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Brazil still angry about ’96 Olympic Games defeat – Lawal

Philomina Ngozi

Enyimba, Sunshine Stars and Plateau Utd jostling to sign Nasarawa’s Seun Sogbeso

Sports Minister Dare Threatens to Sue Radio Presenter, Seek N10bn for Defamation

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy