Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Thiem kpokpo Djokovic, to jam Nadal for Final

World number one Novak Djokovic waka for the French Open don end as Dominic Thiem nack am comot for the French Open semi-final.

Thiem beat am 6-2 3-6 7-5 5-7 7-5 for the semi-final wey bin start on Friday but bad weather come make dem carry am over three times.

 

The fourth seed wey be Theim go now jam 11-time champion Rafael Nadal on Sunday for wetin go be a repeat of last year final.Thiem go be the first Austrian player wey go reach a second Grand Slam final.

 

E still be like feem for the world number 4 as e never kpokpo world number one player for any major before.

 

Dem bin suspend Friday play come later cancel am sake of wind and rain but players don tarsis the organisers wey feel say play suppose resume after the skies bin clear and daylight still remain.

 

The weather no affect Nadal semi-final kpake over Roger Federer as e shele earlier on Friday but Thiem wrap up victory on Saturday afternoon after the third break sake of rain.

 

For Djokovic wey don kolobi 26 Grand Slam matches in a row, dis yakata falling don end im hope to become the first man for the Open era to hold all the four major titles at the same time.

 

Meanwhile, Thiem bin loss for straight sets to Nadal for last year final but e be like dis year na im year and the final on Sunday go determine whether e go fit revenge last year falling hand.

The post Thiem kpokpo Djokovic, to jam Nadal for Final appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Musa keen on away win to complement Pillars’ resurgence

Ex- Flying Eagles Midfielder Micheal Extends Bologna Contract Till 2024

Philomina Ngozi

NFF To Revise 2020 Budget, Cut Down On Competitions To Attend

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy