Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Time for serious business don come – 3SC Manager

As the Nigeria National league go finally start after all the delay wey don worry am, shooting stars of Ibadan don ready to welcome and kpokporise their first opponent for the matchday 1 of the chacha season wey be Abia Comets.

Dis gbege go shele for the Lekan Salami Stadium for Ibadan by 4pm and the media officer of the team wey be Tosin Omojola don yarn say now dem ready for serious business as dem don prepare wella for the chacha season and dem no want make wetin happen last season happen again, so therefore dem wan start ontop better winning mentality as dis one go help dem continue well throughout the season.

 

For the pride of South West Nigeria the second tier no fit dem at all and naim make the management, the technical crew and the players dey ginger to carry the team go back where dem believe say dem suppose dey wey be the elite cadre of the Nigerian league.

 

E tok say the present squad of Shooting Stars, under coach Edith Olumide Agoye coaching get something to prove dis time around and dem dey focused and dedicated to make sure say dem kpake their aim wey be to waka go back the NPFL.

The post Time for serious business don come – 3SC Manager appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Rohr Recalls Musa, Akpeyi For Super Eagles Vs Benin, Lesotho

Philomina Ngozi

Rangers aim for a win in Ethiopia – Madu

CHAN Eagles apologize for Togo thrashing, promise comeback

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy