Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

B4 B4 Brazil football Oga don collect life ban

Tori say b4 b4 Brazil football Oga wey be Jose Maria Marin don collect Akpako life ban sake of say e collect kpogiri wey e no suppose collect in exchange for media and marketing rights dem.

The 86-year-old o also pay fine wey reach one million Swiss francs ($997,000) and dem don command am to forfeit $3.34 million.

 

The world governing join body , FIFA also ban am  from all football-related activities sake of corruption matter.

 

Na the FIFA ethics committee find Marin, wey currently dey US dey serve four-year prison term gility after dem convict am ontop bribery charges last year.

 

For the decision wey dem take, the adjudicatory chamber tok say Marin don breach Art. 27 (Bribery) of the FIFA Code of Ethics and, because  of that,  dem Don ban am for life from any thing wey concern football  whether MA administrative o, sports o or any other, both for national and international level.

The post B4 B4 Brazil football Oga don collect life ban appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

ROUND-UP: Onazi Feared Injured In Trabzonspor Win; Iheanacho, Osimhen, Awaziem Benched

Philomina Ngozi

Injured Super Eagles Right-back returns to Training

Philomina Ngozi

Chikwelu: Super Falcons Not Scared Of France

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy