Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

Dem don release Ahmad Ahmad for France

Tori say dem don release the Confederation of African Football (CAF) Presido wey be Ahmad without any charge after dem ask am questions wey concern one corruption shook eye.

Prosecutor Xavier Tarabeux tok say Ahmad enter one chance sake of shook eye wey connect to criminal conspiracy, corruption, breach of trust and forgery.

 

The football presido wey come from Madagascar bin waka enter Paris to attend the annual governing join body of world football conference, where im dey also serve as FIFA vice presido.

 

Aproko wey dey say Ahmad name come up last March for one document wey dem send give the  FIFA ethics committee wey yarn say e bin dey force im secretary general, Amr Fahmy, to pay bribes.

 

According to Documents wey dey na Fahmy bring the accusations give the committee as e tok say na Ahmad order am to pay some 18,000-euro bribes enter the accounts of presidos of different  African football associations.

 

FIFA  don launch shook eye put for dis tori after plenty corruption matter dem scatter their image since 2015. The world football governing join body don tok say dem go fight to remove any yamayama wey go bring shame come the game.

The post Dem don release Ahmad Ahmad for France appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

In-form Eagles striker Odion Ighalo wants to return to Europe

Israel Adesanya Successfully Defends UFC Title Against Romero

Philomina Ngozi

Top Football Academies In Nigeria –  See The Complete List

Philomina Ngozi

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy