Cornerstone News – Crime News Daily, Accurate News in Nigeria 247 and Super Eagles
FeaturedSport

La Liga done announce salary limit

The La Liga don announce the salary limits of the 20 LaLiga Santander clubs for the 2019/20 season and the total reach 2.94 billion euros for the chacha campaign.

Barcelona continue to dey lead the table as dem take do last season with kpogiri wey dey from 632.97 million euros to 671.42 million euros.

 

Na Real Madrid get the biggest increase, from 566.53 million euros for 2018/19 go 641.05 million euros. Atletico Madrid dey third on top the list with annual wage limit wey reach 348.5 million euros, up from 293 million euros last term.

 

Only five other teams for the top flight get wage limit wey pass 100 million euros:and those teams na Sevilla, Valencia, Villarreal, Athletic Club and Real Betis.

 

Dis na the La Liga salary limits for 2019/2020 (million euros)

1. Barcelona 671.42

2. Real Madrid 641.05

3. Atletico Madrid 348.5

4. Sevilla 185.16

5. Valencia 170.67

6. Villarreal 108.59

7. Athletic Club 103.18

8. Real Betis 100.35

9. Real Sociedad 81.14

10. Espanyol 68.74

11. Celta 62.12

12. Levante 56.60

13. Getafe 56.284

14. Leganes 52.08

15. Alaves 49.77

16. Eibar 47.12

17. Osasuna 38.69

18. Granada 35.46

19. Real Valladolid 32.03

20. Real Mallorca 29.97

 

Make una no expect too much.

 

France Oga wey be Didier Deschamps don hail smallie midfielder wey be Matteo Guendouzi but e don carry warning give say make people no too expect too much of the talented youngster.

 

The 20-year-old bin kolobi im first call up come the national side after the wound wey Manchester United Paul Pogba bin get.

 

Arsenal dey gbadun the combative midfielder and e don enjoy strong start to the chacha season as e dey put in excellent performance wey helep im side kpake one point against Tottenham Hotspur for the north London derby.

 

However, the World Cup-winning manager and player don move to lower expectations of the small boy so that pressure no go dey ontop im head.

The post La Liga done announce salary limit appeared first onCornerstone News Nigeria.

Related posts

Rotherham Boss hails “on fire” Semi Ajayi

Philomina Ngozi

Naija Referees too dey fear – Elahor

Everton Target Midfielder Swoop

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More

Privacy & Cookies Policy